Friday 25 April 2014

CELEBRITY AMEBOR: Jude Okoye's Marriage Proposal Is Child Abuse (cum hear the full tory)

Na jeje I juz sit down before dem come tell me say dem P'Square elder brother, Jude Okoye don finally propose to one girl yesterday. After all hin younger brothers don marry born pikin finish. 

The girl name sef na Ifeoma Michelle Umeokeke. Na one of Jude Okoye's younger brother bring the ofofo come twitter and hin share some pixure join, so that una go no say the Ofofo na confirm.

I even hear say the tin sef be like Child abuse cux Jude Okoye old pass the girl no be small. Some pipu even dey talk say, 'shey na now when hin brothers won separate hin cum see say hin wan marry abi'  *No be me talk all dah one sha ooo.. Cux some pipu sabi put somebori for wahala* 

Na now dem go talk say na Tayo Lawal talk sumtin sumtin. Una don hear now, no be me talk say na Child abuse ooo, na some busy body like u talk am..lolz.  See more pixure below..



No comments:

Post a Comment